Fiziedeen – Mad O

Fiziedeen Mad O

Fiziedeen – Mad O Lyrics

Artist: Fiziedeen
Song: Mad O

Omo all of una know say me I no dey too dey talk
But na matter wey dey happen now I carry come
Whether there’s an afterlife for real I can’t be sure
But if you think these are the last days then you might not be wrong

Get this guy for my compound
Dapo too fine if you see am you go cut cap
Even as a guy you go feel am for your mind
You go say walai my guy jokes aside you too try…

And as expected all the ladies na so them dey line up
Be like them dey pay because my guy monеy dey pile up
As fly dey follow sh#t, as Sarkodiе follow beat
As Zuru dey follow meat, na so barnies them dey sign up

Just for them to be with Dapo, na them dey rush am
And any girl wey you see for street Dapo don knack am
But story the story wey dey go around, e fit give you heart attack
Even though it’s not confirmed I go talk am

Them say as e fine so wey every girl dey want am
Na the one in ten thousand girls wey no rate am
Na she wey my guy go rush choose, e ready to die put
If she no let am chook e go rape am

Ah mad o, this one bad o
Toilet dey but dey people sh#t for church o
Oh Lord God, Oga make you do come
Cos the things wey dey sup for nowadays mehn e mad o

Chei mad o, this one bad o
Toilet dey but people dey sh#t for church o
Sodom bad and Gomorrah sef bad
But the things wey dey sup for Naija now e mad o

Things wey dey sup for Naija (mad o)
Corruption full our land (mad o)
If you too talk them say off your mic (mad o)
If the question hard you fit to faint (mad o)

Them go shoot if you go protest (mad o)
Even if you use the flag sew shirt (mad o)
Army say fake news we trend (mad o)
Adamu dey send Jack threat (mad o)

Yeah, too many things i dey reason for my head like
If we no commot toll gate shebi all of us go dead
How many people them go shoot
How many lies them go tell

How many people them go hide before e start to dey smell
Mr. cunny cunny
I dey on my own you start dey worry worry
You want to chop my money in a hurry hurry

If you want to f#ck me up no do me suffree suffree
I no need touchy touchy i no be butty butty
Your government style e be choppy choppy
If you want to get job e be body body

Abeg help me change the topic before i start to commit
Your words be like vomit
Something happen for the lungu
Lingo wey we dey speak dey make the barnies tingle

Vroom vroom wey we dey race dey make the barnies single
Two grooms start to debate who be the barnie pringle
One burst one for head, one get gun for pocket
Me i take off like rocket, take off like Offset

Ran into ekelebe in the process
Igbo for my socks, them knock my eye socket
Ah mad o, this one bad o
Toilet dey but dey people sh#t for church o

Oh Lord God, Oga make you do come
Cos the things wey dey sup for nowadays mehn e mad o
Chei mad o, this one bad o
Toilet dey but people dey sh#t for church o

Sodom bad and Gomorrah sef bad
But the things wey dey sup for Naija now e mad o
Things wey dey sup for Naija (mad o)
Corruption full our land (mad o)

Reverend sister send nude to Father (mad o)
God just dey dey observe (mad o)
Them go shoot if you go protest (mad o)
Even if you use the flag sew shirt (mad o)

Army say fake news we trend (mad o)
Adamu dey send Jack threat (mad o)
Eclipse Nkasi on the beat (mad o)
Paybac sef dey for here (mad o)

Jonn Deux pon the mix (mad o)
Find more lyrics at https://dcslyrics.com

You can purchase their music thru
DCSLyrics.com Amazon Music    DCSLyrics.com Apple Music
Disclosure: As an Amazon Associate and an Apple Partner, we earn from qualifying purchases

Fiziedeen Lyrics – Mad O

Please support our site by sharing it.
And please follow our site to get the latest lyrics for all your favourite songs.