BadManSpillz – SeniorMadMan

BadManSpillz SeniorMadMan

BadManSpillz – SeniorMadMan Lyrics

Artist: BadManSpillz
Song: SeniorMadMan

Blackboy
Oh nuh nuh nah na na
Dem been dey give me problem
But my God passy dia problem

Dem been no want dey sendi me
But where I come from
Nobody send anybody
Make you dey for your government

For every corner wey you dey
Na men dey govern am
I be king for my area
Na who first craze, na em be Seniormadman [Senior

[Oh nuh nuh nah
Na who first craze na em be Seniormadman
[See
Dem no dey put phone for back pocket go ATM

You go hear word
Mеn go run you street
Your eye oh, you go see blood
Dem no dеy telli blind man say rain dey fall for outside

I say na wahala
For the place wey dem come from [uh nuh no
And if you no sabi do this one
Omo na long talk [uh nuh no

I say I never never never never never never see another type [nuh nuh yea
I say na problem for the place wey I come from
Zanga the place wey I come from
Ghetto boy, get over, get it on

Say she never get another kind of love
From this
From this street
Konji, pon this beat

Na condition, make crayfish bend
Better soup, na money kill am
If life show you pepper
Shey you go use am do pepper soup

No food for lazy man
No be for who get restaurant
If trust dey this life
Shey water for no dey cook fish oh

Dem been dey give me problem
But my God passy dia problem
Dem been no want dey sendi me
But where I come from

Nobody send anybody
Make you dey for your government
For every corner wey you dey
Na men dey govern am o

I be king for my area
Na who first craze, na em be Seniormadman [Senior
[Oh nuh nuh nah
Na who first craze na em be Seniormadman o

[I tell her say na
Pikin wey dey find party rice
No suppose to fear dance
I get am before, oga that one no be property

When the men dey dance, you sef
Go shaky body, you sef
[You sef go dance ololo
[oh nuh nuh yeah ee yeah

BMS, Yea… sheesh…yea..okay!
Find more lyrics at https://dcslyrics.com

You can purchase their music thru
DCSLyrics.com Amazon Music    DCSLyrics.com Apple Music
Disclosure: As an Amazon Associate and an Apple Partner, we earn from qualifying purchases

BadManSpillz Lyrics – SeniorMadMan

Please support our site by sharing it.
And please follow our site to get the latest lyrics for all your favourite songs.